5 New Hardware Wallets
Upgrade your crypto security dis holiday period with some of di latest hardware wallets wey dey for market.
Phantom na di most popular software wallet for di Solana ecosystem, and e dey everywhere because na beta product.
But one problem dey, Hot wallets too dey easy to create, so plenti pipu dey open am and ddem dey forget to back up di recovery phrases wey dem get during setup.
Dis method dey okay… as long as you still fit access your wallet. But if you lose access? Your magic internet money go hook forever.
One recent Phantom update don show us di kyn risk wey dey. Di update do mistake reset some iOS user wallet, wey cause permanent loss of funds—some pipu even lose dia life-changing amounts because dem no save dia recovery phrases.
Dis kind tori dey remind us say we always need to dey backup awa keys. But e dey also show why hardware wallets beta for crypto holders. Dis devices dey usually force recovery backups during setup, dem dey work well with apps like Phantom, and dem dey provide strong protection against hacks.
So, if you get good hardware wallet, e go really help. With holiday season don dey come, you fit wan buy crypto gadgets for yourself or other crypto holders.
Di good news be say plenti options dey now. Popular models like Ledger Nano S and Ledger Nano X still gallant, but make we yarn about 5 new devices wey land dis year!
1. Burner — $19
Burner hardware wallet na simple and cheap device wey dem design to make am easy to dey dash stablecoins easy. You fit still use am as full wallet. E dey work with NFC technology and fit connect directly to your smartphone browser without say you dey need any app.
Burner no get complicated setup because e no require you to manage seed phrases. E come with native stablecoin, USD II, wey dollar dey back, plus gas fees wey dem subsidize.
Dis one dey perfect to dey dash crypto without all di wahala, but make you know say dem go start to dey release am for December 2024.
2. Trezor Safe 5 — $169
I don always like Ledger, but Trezor na anoda top hardware wallet maker wey dey do well. Dia latest model, Trezor Safe 5, you fi check am out.
Di main features na:
1.54” color touchscreen with haptic feedback
Strong Gorilla Glass surface
High-level security like EAL 6+ Secure Element and PIN/passphrase protection
Di device dey support advance backup options, like 20-word multi-share recovery system, and you fit use am with thousands of coins.
Plus, e get special orange Bitcoin-only edition wey dem design for pipu wey dey dedicated to Bitcoin—na option wey make sense.
3. Ledger Flex — $249
If you like big screen, Ledger Flex fit be di one for you. Dis new hardware wallet get 2.84” E Ink touchscreen wey make am easy to read transaction details.
Di device get customizable lock screen, so you fit show your favorite images or NFTs, even when e dey off. Na Secure Element chip and Ledger OS dey power am, wey make am beta option for pipu wey dey active across plenty chains and coins.
Ledger Flex still get beta backup feature through Ledger Recover.
4. Ledger Stax — $399
Ledger Stax price choke but na premium hardware wallet option. E get big 3.7” curved E Ink touchscreen wey make am feel like small smartphone.
Di Stax dey support wireless charging, multi-device connectivity (iOS, Android, and desktop), and di battery fit last for days on standby. E get practical and optimized design for beta user experience.
You fit customize di display to show NFTs or personal images, plus e come with Magnet Shell for extra protection and easy stacking if you get more than one device.
5. dGEN1 — ~$460
dGEN1 be like upgraded mix of mobile phone, hardware wallet, and Ethereum light node. E get two touchscreens:
3.95" main display
1.71" secondary screen
E get hardware wey dey optimized for crypto, wey dey support secure transaction validation, crypto-based messaging, and other features.
Dem design dGEN1 as “everyday carry” for Ethereum fans. As i dey yarn now, e dey available for pre-order thru NFT mint on Base, for almost $500 worth of ETH per device. Dem plan to start shipping by Spring 2025.