BITCOIN
Pidgin Parlour, aw una dey?
Aw una dey enjoy dis bullrun, evribodi just dey shine teeth like tiff dis season.
We see as bitcoin just dey pump, as i wan drop dis artikul, di price just dey change go, i go just dey edit, change di price to di latest one😂
Anyaw sha, we don dey di Bitcoin halving season wey dey always show face evri 4 years, so make we gada look dis Bitcoin wey evribodi dey always yarn, some of us go sabi am wella, but we go deep am small.
Bitcoin, wey come from one pesin or group wey dey use di name Satoshi Nakamoto, first show face for 2009 as di first blockchain.
Dem build am on top peer-to-peer network, Bitcoin run im own digital currency wey be BTC and e no get any central authority. BTC dey allow direct and secure transactions between pipu as dem no need any bank to epp dem run am.
Apart from dat, Bitcoin wey get maximum supply of 21 million coins and worldwide recognition dey make am serve as store of value and one kind of protection against inflation, wey dem dey call digital gold.
How Bitcoin dey work
Bitcoin blockchain dey work as one kind of financial book for transactions wey network of nodes dey maintain.
Dem dey group transactions into blocks and miners go verify am thru one process wey dem call Proof of Work (PoW). Miners dey solve mathematical problems wey choke to take confam transactions and add new blocks to di chain, and dem go get Bitcoin as reward. Dis decentralized way wey everybody gree with dey make sure say di system dey secure and e no go fit allow make pesin spend Bitcoin twice.
Wetin bi Bitcoin Scaling Solutions
Bitcoin, lyk Ethereum, fit scale di number of transactions wey e fit handle thru external execution environments. Even tho Bitcoin own scaling options no plenty reach Ethereum own, e get different projects wey dey try handle am. Some of dis projects na:
⚡️ Lightning Network — Na payment channels protocol wey dey allow fast and cheap BTC transactions directly between users.
🧱 Stacks — Na Layer 1 (L1) blockchain, people dey see am as Bitcoin Layer 2 (L2), wey dey add smart contract abilities on top Bitcoin wey no go change hin main protocol.
💻 BitVM — Na system wey focus to expand Bitcoin doings thru offchain program execution, wey dem dey normally use for Bitcoin bridges wey dey trust-minimized.
🦬 Bison — Na zk-rollup Layer 2 for Bitcoin, wey dey use STARK cryptographic proofs togeda with Ordinals tech to take help data storage.
Bitcoin Movement
🟠 BTC price: ~$60,000 (Up 110% over di past year)
📈 BTC market cap: $1 trillion (3x ETH’s current market cap)
🔌 Bitcoin daily hash rate: ~600 Ehash/s (near di all-tym high mark)
🌐 Global Bitcoin nodes: ~54,000 (down from a peak of 200k in 2018)
🔋 Lightning network capacity: ~$250 million (near di ATH mark)
How you fi start Bitcoin
To begin use Bitcoin, you go need two tins: BTC and Bitcoin wallet.
Di simplest way to get BTC na to buy am for crypto exchange platform lyk Binance, ByBit, Coinbase or Kraken. You no need buy plenti BTC at once; you fit buy am small small as e dey convenient for you.
If you don get BTC, put am for personal wallet wey you dey control. If you wan get di same experience wey resemble wetin you dey use for Ethereum or Solana ecosystems, try browser extension wallets lyk Leather, Magic Eden, or Xverse. All dis wallets dey support BTC, Ordinals, BRC-20s and rare sats.
Bitcoin NFT Ecosystem
Dem first get di NFT assets idea for 2012, for di Bitcoin community thru wetin dem dey call "Colored Coins." Tins begin bubble again for 2014 when Counterparty launch, na protocol wey dem design to create digital assets on top Bitcoin.
But di biggest tin wey apun for di Bitcoin NFT ecosystem so far na around Ordinals, na system wey dem create for digital artifacts for Bitcoin and dem first introduce am for January 2023.
Di way dem create Ordinals na say dem go put data for each satoshis, na process wey make dem dey unique and tradable lyk Bitcoin-native NFTs. DIs idea don turn satoshis to collectible items, lyk "rare sats," and e don open way for innovations lyk recursive inscriptions wey fit make Bitcoin NFT collections choke.
Since dem release Ordinals for Bitcoin, e don cause plenty activity for Bitcoin's NFT scene, e don inspire innovations lyk BRC-20s and Runes, and e don jinja interest for older ones lyk Bitcoin Stamps. Some NFT projects wey don dey hot recently na NodeMonkes, Bitcoin Puppets, Bitmap, and Pizza Ninjas.
Bitcoin Future
E no be lyk Ethereum wey get ambitious development roadmap, Bitcoin just dey cruise mode and e no get any major network upgrades wey dem plan soon. Dis cruise mode don make Bitcoin dey more acceptable to di mainstream as we don see for di recent approval of BTC ETFs for U.S.
Even with evritin wey don xup, di network don become strong base for external protocols lyk Ordinals and Stacks wey fit carry dia doings go new levels. As tym dey go, we dey expect to see more projects wey go build ontop Bitcoin thru dis kyn of additional layers as don begin bubble again since 2023.
But, challenges still dey. For example, Bitcoin's mining rewards dey halved every four years(dem dey call am Bitcoin Halving), and this fit make am no dey too profitable to secure di chain as tym dey go if transaction fee revenues no rise well to cover di shortfall. Besides, e be lyk say pressure go increase for Bitcoin to move to di greener Proof-of-Stake (PoS) consensus model as environmental concerns about di PoW mining approach still dey.
To cut di tori short, as bitcoin dey hot go base on store of value and platform for technological exploration, di future dey shine well. Di commitment of Bitcoin community to take maintain di network's foundation principles while dem dey experiment with new layers of functionality don promise say di original blockchain go still dey lead di cryptoeconomy for long tym.
If una enjoy dis tori make una make sure say una subscribe, like am, share join and no forget tell your padi say web 3 don land for street💯