Gitcoin Passport, Your Web3 Evidence Say You No Be 419
Pidgin Parlour, aw una dey? Omo e don tey small wey we drop beta tori here, abeg make una no vex. Man gats run one or two.
Anyhow sha, everywhere good, everywhere stew, men don mount and updates go begin flow again.
So today, i don bring update, una don hear about Gitcoin Passport?
Make una no worry, i go dey gist una wetin e be. As i dey yarn una like dis sef we dey Gitcoin Grants Season and di current round na #GG19 and Pidgin Parlour dey di round🎉,una fi donate as little as $1 to us, make una show us love.
So to donate to Pidgin Parlour or any other projects wey you like, you gats get Gitcoin Passport and your passport score gats dey above 15 so dat your donation go count.
You fi dey ask, which one be Gitcoin Passport again, make una no worry, i go yarn una everything una gats sabi about am.
Wetin Be Gitcoin Passport?
Gitcoin Passport na application wey dem dey use confam pesin identity. Gitcoin don write software wey go make pipu fit gada beta information about demsef and organizations. Dis information go help sabi who you be. Users fit gada 'stamps' from different places for web2 and web3 like Bright ID, Proof of Humanity, Twitter, and Google.
Gitcoin Passport na like center wey dey gada all di decentralized credentials from different places, wey go show say you be pesin wey dem fit trust without say dem need collect ya personal information. Dis process go help prevent fake identities for di whole system.
How you fi Create Gitcoin Passport?
You fit sharpaly create your Gitcoin Passport with di Gitcoin Passport app, but make I yarn you more tori of how you go run am.
Set Your Wallet
First, you gats get Ethereum account. Accounts na wallets wey dey store money and data for Ethereum network, and na your cryptographic keys dey protect am. You fit use wallet enter your account. If you never get Ethereum wallet before, you fit create one.
If you don get your Ethereum wallet, waka go Gitcoin Passport app for passport.gitcoin.co.
Sign Enta Gitcoin Passport
When you land for di app, you go see option wey talk say "Sign in With Ethereum". E go allow you sign in without say you need carry ya data waka go any central organization - your wallet go use your cryptographic keys show say na you get di account.
If you don click "Sign in with Ethereum", e go tell you make you connect your wallet.
“Your Passport dey follow your Ethereum address, so make you connect di wallet wey you dey use steady. E go help you gada Stamps as you dey waka for Web3!”
As your wallet don connect, e go tell you make you sign message. Signing message na how you go take show say you be di owner of dat particular address, and say you don give permission for sumtin. For dis mata, you dey allow di app make e sign in with your Ethereum account, so e fi see your data for one data network wey dem dey call Ceramic.
If na di first time wey you dey use Passport app, dem go create new Passport for you. You no go first get any Stamps, but you dey ready to start to gada dem and generate Passport score.
Wetin be Stamps?
If you don create Passport already, you fit begin collect evidence to show say you be sure pesin. Na Stamps you go use do am.
Stamps na evidence wey you fit show say you get account or you dey active for other platforms. If you gada all dis Stamps for one place, Gitcoin Passport go gada your online identity for one place. As you dey gada more Stamps, your evidence go strong and you go fit get more access and influence for di web.
How you fi Gada Stamps
If you don sign in to Gitcoin Passport app, you go see Stamps and score for di corner of di page.
Even tho each Stamp get different way wey dem go take confam am, di process na di same:
Passport app go show you how you fi join different identity providers. Dem go ask you to allow dem waka thru your account data. Gitcoin Passport no dey store or carry your data go outside - di app just dey check say di data dey there true true.
Passport app go yarn with di Gitcoin server to give you Stamp. Dis Stamp na to show say you na you get di account. Your account details dey coded - di only thing wey di Passport go share na di evidence wey show say na you get di account, e no go show anything about your account.
Di Evidence go save for your Passport, so any app wey you show your Passport go fit see am to give you access to things wey dem dey protect or communities.
For example, if you wan confam ENS Stamp, you go need buy .eth address from ENS. Afta you don run am, go back go di Passport App and 'Connect Account'. Dem go tell you to sign message for your wallet before dem confam di Stamp for your Passport.
Some of dis Identity providers get dia own way to confam wey fit take small time. But once dem don confam you there, e go quick gada di Stamp wey you need.
If una enjoy dis tori make una make sure say una subscribe, like am, share join and no forget tell your padi say web 3 don land for street💯