Make We Reason Lido
Ethereum, wey be di world second-biggest cryptocurrency for market cap, don popularize di concept of staking, na process wey dey allow holders earn rewards as dem dey participate for di network security. Among di many staking solutions, na Lido dey shine wella as di biggest liquid staking protocol, wey dey play important role for Ethereum's staking system as e be so.
Wetin be Lido
Lido na decentralized liquid staking solution wey dey operate for Ethereum, Solana, and Polygon blockchain networks. E dey allow users stake dia tokens and earn rewards without locking up dia assets. When you stake crypto with Lido, you go receive utility tokens (like stETH for ETH, stSOL for Solana’s SOL, and stMATIC for Polygon’s MATIC) in return. Dis tokens represent your staked assets and di rewards dem dey earn.
So far, di most popular token wey Lido mint na stETH, wey represent staked ETH. Di value of stETH dey pegged to di value of ETH, and e dey increase with time as staking rewards dey accumulate.
Why Lido?
Lido get plenty advantages for stakers.
🪙 E dey comot from di wahala of running your own node, wey fi dey hard technically and e dey chop time; for example, you fi just buy stETH to stake!
💸 E dey also allow you stake any amount of tokens, no be like Ethereum's native staking system wey need 32 ETH.
💱 Tokens wey Lido stake like stETH dey usable for DeFi, e.g. as collateral for borrowing protocols like Maker, so you fi dey liquid and still make use of your crypto while you dey earn steady staking income.
Governance for Lido
Lido dey operate under decentralized governance model. Pipu wey dey hold LDO tokens get power to make decisions about di future of di protocol. Dem fi vote on proposals and influence important parts of di protocol. Lido also get security measures wey dem put for ground to protect stakers and make sure say di protocol dey run smoothly.
How to stake ETH on Lido
To stake your ETH on Lido no too hard like dat, just follow dis simple steps:
1. 👛 Connect Your Wallet: Visit di Lido Staking Portal and click on "Connect Wallet" wey dey top of di page. You go need to connect a Web3 wallet like MetaMask wey get di ETH wey you wan stake.
2. 🔢 Enter di Amount to Stake: Once your wallet don connect, you fi enter di amount of ETH wey you wan stake for di "ETH amount" field.
3. 💎 Stake Your ETH: After you don enter di amount, click on di "Submit" button to start di staking process. You go need confirm di transaction for your wallet.
4. 🙌 Receive stETH: Once di transaction don confirm, you go receive an equal amount of stETH tokens for your wallet. Di exchange rate na 1 ETH = 1 stETH. Dis tokens represent your staked ETH and di rewards wey dem dey earn.
5. 🔍 Monitor Your Staking: You fi monitor your staking rewards and di total amount of ETH wey pipu don stake with Lido for di same page. Di current annual percentage rate (APR) for staking ETH with Lido go dey display (e dey 5% for now), along with di total staked ETH and di number of stakers.
Before you begin, get am for mind say Lido dey charge 10% fee on staking rewards, wey dem use to support di operation and development of di protocol.
Risks for Lido
When you dey participate for Lido, like any other DeFi project, e get im own set of challenges. E dey important to sabi dis challenges before you decide to stake your ETH. Dis na some of di potential risks wey you fi encounter when you dey stake for Lido:
🐜 Contract Vulnerability Risk: Lido's operations dey based on smart contracts. Even tho di code na open-source, don undergo audits, and get bug bounty program wey dem use reduce risks, di possibility of bugs or vulnerabilities for di smart contracts still dey exist.
🗡️ Slashing Penalty Risk: Validators for Ethereum fi face penalties if dem no fulfill dia responsibilities wella. Lido dey address dis risk by distributing di stakes across different professional and trustworthy node operators wey get different configurations. To add join, Lido dey maintain insurance fund, wey dey financed from dia fees, to provide additional risk mitigation.
📉 stETH Value Risk: Di market price of stETH fi fall below hin intrinsic value because of Lido's withdrawal limitations, wey fi affect arbitrage and market-making activities.
Additional Resources
For more information about Lido, you fi explore dis additional resources:
1. 📚 Lido's FAQ
2. 🦎 Coingecko LDO Hub
Dis resources go help you gain better understanding of Lido and make sure say you make informed decisions about staking your ETH.
CONCLUSION
To cut di tori short, Lido dey provide one interesting solution for pipu wey wan stake for Ethereum, Solana, and Polygon. E dey combine di advantage of earning staking rewards with di flexibility to maintain liquidity, wey make am attractive for both new and experienced stakers.
By using Lido, stakers fi benefit from earning rewards without locking up dia assets, participate in decentralized governance, and make use of dia staked tokens for DeFi activities. Di protocol also prioritize security and protection of stakers' funds.
Whether you be new staker or experienced one, Lido fi be good choice if you dey interested in staking on Ethereum, Solana, and Polygon networks.
Proverb Of di Day
Better soup, na moni kill am
Make una make sure una share give una padi dem, tell dem say make dem come read about web3 for pidgin. Una sabi as e be na!
Make una also follow us for our social platforms
Make you no go snooze, make una join di movement and we go gather build beta future together.
Make una watch out for more content wey go dey come from pidgin parlour.
Make una learn more about web3 for here👇
https://rss.com/podcasts/pidginparlour/731518/ https://rss.com/podcasts/pidginparlour/804421/
Follow we for Twitter : https://twitter.com/PidginParlour
Follow we for Facebook : https://www.facebook.com/pidginpalour?mibextid=ZbWKwL
Follow we for linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z
Subscribe for here : https://tinyurl.com/mryh8j5w
Awa website : https://banklessafrica.com/
Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S
Join we for telegram https://t.me/banklessafrica
Una Thank You o!