Una Gm my pipu, aw una dey? E sure me say una gallant, No shaking 😁
For today mata, we go quick reason Metamask and di new Snaps feature and other things for di wallet wey plenti pipu dey use well well.
MetaMask na one popular Ethereum-based software wallet and browser extension wey dey allow users reason decentralized applications (dapps) from dia device.
E dey give users friendly interface to manage ETH and Ethereum tokens, and e still fi manage tokens wey dey other blockchains or layer-two (L2) scaling solutions wey dey work with Ethereum Virtual Machine (EVM) like Arbitrum, BNB Chain, and plenty others.
MetaMask History
MetaMask bin start for 2016 by Consensys as browser extension wey dem fit use for Chrome and Firefox web browsers. E no too tey before Ethereum developers and users begin chook eye for am.
Since den, MetaMask don expand dia way of doing things by adding support for new browsers like Brave and dem still launch mobile app wey dem design specially for iOS and Android devices.
As time dey go, MetaMask begin add new services to dia package like native decentralized exchange (DEX), bridge aggregator, way to buy crypto, and place where you fi stake ETH. All dis things e add don help MetaMask stand gidigba as di main Ethereum wallet wey pipu dey rush.
MetaMask Movement
For July 2020, MetaMask bin get just 540,000 monthly active users (MAUs). One year later, around August 2021, di number increase to 10 million MAUs, and by March 2022, e increase again reach 30 million MAUs.
E no too clear wetin MetaMask current stats be now, but we fi talk say di wallet na di app wey pipu use pass for all of crypto, as per say e dey popular.
How to use Mask wallet
If you wan use MetaMask wallet, follow dis steps:
1. Install di MetaMask browser extension from dia official website or download dia mobile app for di device wey you wan use.
2. Follow di instructions wey dey inside di app to create new wallet, including setting password and make sure say you store your recovery phrase securely.
3. Once di wallet don dey ready, you fi add ETH and other tokens wey e support to your wallet and you fi begin to dey use dapps. If you wan add chains wey pass Ethereum to your wallet, tools like Chainlist go make the process easy for you.
MetaMask Portfolio
For September 2022, MetaMask bin introduce di beta version of dia new Portfolio Dapps dashboard system.
If you wan use am, go portfolio.metamask.io and connect your wallet, dis user-friendly interface (UI) go show you all your moni for different accounts and networks. You go fi see aw much moni you get, your DeFi activity, and your NFTs all for one place.
E fi work for both di browser extension and mobile app versions of MetaMask, and e dey simple to manage your accounts and moni for all di top EVM blockchains and L2s like Ethereum, Optimism, Polygon, and others. Dis UI still make am easy for you to access all di MetaMask services like Buying, Bridging, Staking, Swapping, and plenty others.
MetaMask Snaps
Consensys introduce MetaMask Snaps for September 2023, MetaMask Snaps na new plugins system wey dem design so dat Metamask go fi do things wey pass wetin ordinary wallet fi do.
Dis plugins, wey dem dey call Snaps, dey allow developers build custom connections and make user experience beta inside di MetaMask environment. From adding new kinds of tokens standards to connecting with chains wey no be Ethereum, dis system don give way to expand MetaMask's power small small.
No Looseguard with your Metamask
Even as Metamask dey provide way to take manage your digital assets, you sef gats dey extra careful, follow steps wey go keep your funds safe:
🔒 Make sure you dey store your recovery phrase for one secure, offline place wey no dey online.
🚫 No ever share your private keys or recovery phrase with anybody, at all.
🔐 You fi create one strong and unique password for your MetaMask wallet.
🔏 Reason use hardware wallet togeda with MetaMask for beta security.
🛡️ You fi turn on "phishing detection" for your MetaMask settings.
🔥 Download wallet warning services like Fire so you go fi understand your transactions well well.
Make sure say you follow dis steps well, cos if you snooze, omo you lose o.
Additional MetaMask resources
For more information and resources about MetaMask, you fi reason dis links:
In Short
MetaMask get one very important role for di Ethereum world. E dey give millions of users easy way to dey use decentralized applications. As di world of decentralized finance (DeFi) and NFTs dey grow well well, MetaMask no doubt go remain one important tool wey dey manage digital properties and to explore all di things wey dey inside di cryptoeconomy.
Proverb of Di Day
Pesin no dey learn aw to use left hand for old age
If una enjoy dis tori make una make sure say una subscribe, like am, share join and no forget tell your padi say web 3 don land for street💯
Una Thank You O!