Sam Bankman-Fried don go Jail Afta Judge Cancel im Bail
Mr. Bankman-Fried don dey aous arrest for im mama and papa aous as e dey wait trial for charges wey come from di crash of im cryptocurrency company, FTX.
My Pipo,
Beta gist don dey o, una sabi SBF na! Di popular FTX founder wey im company crash, im don finally go jail.
Afta e don test di patience of di judge wey dey handle im fraud case, FTX scammer Sam Bankman-Fried don allow dem cancel im bail last week and e don land for jail...
Dem don carry Sam Bankman-Fried - SBF, di founder of di cryptocurrency exchange FTX wey crash, go jail on Friday afta one federal judge for New York cancel im bail. Di judge talk say im bin dey try influence witnesses wey go testify against am for di trial wey many pipu dey expect, in di next two months.
Mr. Bankman-Fried, wey be 31 years old, don dey under house arrest for im mama and papa aous for Palo Alto, Calif. Since wen dem don arrest am for December on top fraud charges wey relate to FTX's crash. But for one hearing wey apun on Friday, Judge Lewis A. Kaplan of Federal District Court for Manhattan talk say dat arrangement no go fi continue. Prosecutors talk say Mr. Bankman-Fried don try disturb witnesses two taims for di case, including say e give documents to reporters.
"E don pass im boundary, and I go cancel di bail," na wetin Judge Kaplan talk from di bench.
Afta dem read di order for court, two U.S. marshals come tell Mr. Bankman-Fried make e comot im tie and navy suit jacket as dem wan handcuff am. Him mama, Barbara Fried, bin dey dere with im papa, she try waka go meet am, but one court officer tell her say make she go back. Dem carry am go Metropolitan Detention Center wey dey Brooklyn.
One of Mr. Bankman-Fried lawyers, Mark Cohen, talk for court say dem dey plan to appeal. Judge Kaplan come talk say e no go wait make di appeal finish before e send Mr. Bankman-Fried go jail.
Di drama for di courtroom be di latest embarrassing tin wey apun to Mr. Bankman-Fried since im cryptocurrency company don crash, one of di most shocking crashes wey don happen for recent taims. FTX flex di sweetness of virtual currency market, e become one of di leading companies for di industry, before e come file for bankruptcy afta customers wan withdraw dia money around december. Within small taim, Mr. Bankman-Fried wey be one big person wey industry dey respect, wey politicians and celebrities dey run come meet, e don become one criminal defendant wey go tey for prison.
Now e go nid prepare for im trial wey go start on October 2, from inside jail cell.
Di court discussion about im bail na based on one artikul wey New York Times publish last month, wey talk about private writings by Caroline Ellison, one executive wey dey inside Mr. Bankman-Fried's business empire, and she bin date am join. Ms. Ellison don plead guilty to fraud charges and don gree to cooperate with prosecutors wey dey investigate Mr. Bankman-Fried.
For court documents, prosecutors talk say Mr. Bankman-Fried don give di documents to The Times so dat e go intimidate Ms. Ellison, and e cast her as bad pesin before him trial. Dem also notice di plenti taim wey Mr. Bankman-Fried dey yarn with pipu for media, including author Michael Lewis, wey dey write one book about FTX wey go dey ready to publish for di week wen di trial go start.
As dem bin dey drag di bail mata for court for di recent weeks, Judge Kaplan impose one temporary gag order wey stop di FTX founder and im representatives make dem no follow media yarn.
Lawyers for Mr. Bankman-Fried talk say as e give di documents to The Times, e dey exercise him right to answer "questions from di media" and say e no breach di terms of im bail agreement. The Times, di Reporters Committee for Freedom of di Press, and one pesin wey dey make film about Mr. Bankman-Fried, dem submit court documents wey show concerns about di gag order wey Judge Kaplan put.
Di situation of di order no too clear afta dem carry Mr. Bankman-Fried go jail on Friday. But for court, Judge Kaplan talk say "defendant speech no dey protected if na to cause one crime."
E talk say e don conclude say Mr. Bankman-Fried communication with media and di separate attempt wey e take contact one former FTX employee na to "intimidate or also to influence" witnesses for di case.
One spokesman for Mr. Bankman-Fried no wan talk anything. One spokesman for di U.S. attorney’s office for di Southern District of New York, wey dey prosecute Mr. Bankman-Fried,dat one too no gree respond to request for comment.
Na for Bahamas dem bin arrest Mr. Bankman-Fried, na dere be FTX base, afta di company crash for November. Dem charge am say e dey use customers funds finance luxury real estate, political donations, and charity. Afta some days for Bahamas jail, dem carry am come United States, release am with strict bail conditions wey talk say him gats dey wear ankle monitor and im no fi comot him mama and papa aous. E don plead not guilty.
Since dem release am, dem don warn Mr. Bankman-Fried plenti taim for behavior wey prosecutors talk say e don dey cross di boundaries of wetin dem fi allow am do as e dey wait for trial.
For court documents for January, prosecutors bring evidence say e don dey send messages to one former FTX executive wey fi be witness for di case, e dey ask to follow am yarn. Dem also talk say Mr. Bankman-Fried bin use virtual private network (VPN), wey be tool wey dem talk say fi disguise how e dey use internet while e dey wait for trial.
During dat taim, Judge Kaplan order Mr. Bankman-Fried say e must agree to bail conditions wey go choke am, wey go limit which websites e fi use and e no go fi follow di former FTX employees yarn. Visitors wey dey go im mama and papa aous no go fi carry phone or computer enta.
As e no dey common make dem cancel bail, especially wen di trial date dey close, e fi happen wen judges believe say di defendant actions fi threaten di community or di witnesses.
Judges get "good bit of discretion" wen na taim to revoke bail, na wetin Erik Gordon, wey be law and business professor for University of Michigan talk. "If you dey on bail, you no wan go near anything wey go be like you wan force witness."
The Times article about Ms. Ellison include section from private Google documents wey she send to Mr. Bankman-Fried, where dem write about dia relationship and her own insecurities as chief executive of Alameda Research, one hedge fund wey Mr. Bankman-Fried create. For court, prosecutors argue say di sensitive nature of di writings show say Mr. Bankman-Fried dey try intimidate and tarnish di image of im former girlfriend.
"No set of release conditions fi assure di safety of di community," na wetin Danielle Sassoon, one of di prosecutors, talk for one hearing last month. "Di defendant don show say im get am for mind to exploit di conditions wey dem give am for release to influence dis trial for way wey no pure."
For Judge Kaplan, di artikul about Ms. Ellison na di final straw. Mr. Bankman-Fried message to di former FTX executive, wey serve as general counsel for di company U.S. division, be like say e wan make am "sing from di same hymnbook," na wetin Judge Kaplan talk for Friday. And as e share documents with The Times, e mean say Mr. Bankman-Fried wan paint Ms. Ellison for bad way.
As Mr. Bankman-Fried lawyers dey fight make dem keep di bail agreement di same, dem argue say di conditions for Brooklyn detention center go make am hard for am to prepare for di trial.
Judge Kaplan talk say im fi agree make dem transfer Mr. Bankman-Fried go anoda facility wey go fi offer am beta internet access, like one detention center for Putnam County, N.Y.
E talk say e dey willing consider arrangement wey go allow Mr. Bankman-Fried meet with im lawyers for dia office, but e go get tight security.
For now, Mr. Bankman-Fried go dey stay for di federal facility wey dey Brooklyn. For court documents, im lawyers talk say di jail dey face "staffing crisis" and pipu wey dey inside no dey get plenti access to computer.
Di location "no dey anybody list of five-star facilities," na wetin Judge Kaplan talk for Friday.
Oya make una quickly reason dis poll give us feedback.
Proverb Of Di Day
Today newspaper, na tommorow suya wrap
If una enjoy dis tori make una make sure say una subscribe, like am, share join and no forget tell your padi say web 3 don land for street💯
Una Thank You O!